Posted in Poetry

D is for Drown and more – an instantaneous duet

By

Toyosi Arigbabuwo and Noel Ihebuzor

NI

Crown, drown, clown…..”

TA

for which town?

Abeg, chill naa, no vex

NI

I no vex, I no frown!

Dem jus fall my hand down!

TA

Me dey here wan wear LASTMA gown

I no know say you dey only play with noun

My fine white skin, don nearly turn to brown!

NI

na so so frown frown

when town vex come meet crown

sake of say ogogoro wey him down

wey make dem talk of drown

TA

E come be like this town

When dem goon

Say no be madness make the crown

Wan drown pipu for inside Lagoon

NI

Chei, Baba God him dey frown

Him no go gree sey make clean pipu drown

na float wey eagle feather dey float for water,

leg wey waka come go waka go,

nothing do am, nothing fit do am.

TA/NI 

Iseeeee! Aseeee!

**** Toyosi and I wrote this instantaneous duet as an expression of our strong disapproval of royal meddling in inter-ethnic amity! Readers in Nigeria will be familiar with the context.TA is Toyosi’s voice, NI is mine.

Author:

Development and policy analyst with a strong interest in the arts and inclusive social change. Dabbles occasionally into poetry and literary criticism!

Leave a Reply

Fill in your details below or click an icon to log in:

WordPress.com Logo

You are commenting using your WordPress.com account. Log Out /  Change )

Twitter picture

You are commenting using your Twitter account. Log Out /  Change )

Facebook photo

You are commenting using your Facebook account. Log Out /  Change )

Connecting to %s